Uploaded By
VIEW PROFILE
188 Followers
If I carry my pen and my Pepper
Make I write how e Dey do me
I no go finish Walahi
And if I delete all my texts when I send to you
Before you come online,to read am
I no wan stress you My guy
Life no easy for anyone
You fit Dey complain
Make I no complain
But my problem fit big pass your complain
Gimme some shots of achohol
Make I high
Lemme get all these stress off from my mind
Even though they be back after some time
Gym instructor no fit to carry
Carry
Carry this weight off from my chest
Gimme something Wey fit carry
Carry
Carry this pain away my Dear
Life no be Tea and sugar
I Dey try "free my mind" like Omah(OmahLay)
Life be the war and na me be the Soldier
One battle come,I Dey shoot,i turn around see Another
But them sey as a man tears no suppose drop
But me I no send that yey
- Release Date:April 4, 2024
- Producer:Toryye
- Genre:Afrosounds




