Uploaded By
VIEW PROFILE
61 Followers
(Intro)
Na Gahby Pitchboy ….
Verse 1
Every night I dey cry but nobody dey know
Fake smile for my face, but my heart don cold
I dey ask God why my blessings come slow
Why everywhere dark, where the light wey I know?
People dey laugh, say I go surely blow
But dem no know wetin I dey carry for soul
Many scars for my chest, many wounds never close
Sometimes I just tire, I wan leave it all go
Chorus
Pain no dey hide, e dey show for my eyes
Even when I smile, many things no dey right
I dey pray make tomorrow better pass tonight
Cause this heavy heart no fit carry this life
Pain no dey hide, e dey show for my eyes
Who go save me when I don lose all my light?
Lord abeg hold me, make I no lose this fight
Cause deep inside me, I just wan feel alright
Verse 2
Friends turn strangers, love turn to lies
Promises scatter like smoke for the sky
I don trust people tire, all of dem don deny
Now na lonely road and na me dey survive
Mama tell me “son, no give up on your dream”
But sometimes e hard to believe wetin I see
If to say tears fit talk, dem go tell una plenty things
Say this small boy don suffer more than him age fit bring
(Outro)
Na Gahby Pitchboy.
- Release Date:June 29, 2026Ⓡ
- Album:unknown
- Genre:Afrosounds




